Thursday 31 January 2013

9JA COMPLAINT

U dey do opening prayer 4 Night Club.
- Na God go slap ur mouth.
U come back from dubai dey form British accent.
- Na rat go chop ur mouth
U be house boy u come dey play Rick Ross - I am the Boss.
-4 where na.....mumu
U dey add water to egg say e go plenty when u fry am.
- Why u no add yeast join am....olodo.
U no go university, and u dey find ur name for NYSC posting.
- Na yeye dey worri u.
House dey burn, you wan use gas do fire extinguisher
- Hahahahaha....u don die.
U de say Terry G's music dey inspire u
- unto which level!! madness
U carry candle dey look for where fuel dey smell from.
-continue u go soon see am
U call MTN to tell dem sey ur free browsing has stopped working.
- Lolzzzzzzzzz... ..mad man
When pastor talk say 'Do something crazy for the Lord' u come carry church offering run
- na who wan chase u?

No comments:

Post a Comment